Views: 9
Dem don swear President John Dramani Mahama into office for one colourful ceremony wey occur for di Black Star Square for di kontri capital, Accra.
Di swearing-in dey happun afta im strong victory for last month presidential elections.
Also for di first time for di history of Ghana, di kontri don get female Vice President, Professor Jane Naana Opoku Agyemang.
Earlier on Tuesday, dem swear in new Members of Parliament and di speaker.
Mahama bin serve as President of Ghana bifor from 2012 to 2017.
Twenty one heads of state including Nigeria President and Chair of ECOWAS Bola Tinubu dey dia to witness di event.
Mahama dey enta office for time wey Ghana dey recover from dia worst economic crisis inside one generation.
Expectations dey high, but Oga Mahama don promise to turn di economy around.
For di election, di opposition National Democratic Congress (NDC) win 56.55% of di vote while di New Patriotic Party get 41.61%.
Dis na election wey di opposition bin win by almost 1.7 million votes.
Heads of state and oda dignitaries wey dey attend di event
Tok-tok pesin for di president-elect transition team Felix Kwakye Ofosu tok say dem dey expect at least 21 heads of state including Nigeria President Bola Tinubu and Kenya President William Ruto.
Kenya president William Ruto also dey di kontri for dis inauguration afta im promise John Mahama for December say im go attend di event.
Two former presidents go also attend di event for di kontri capital Accra.
Two vice presidents, one speaker of parliament and reps from global bodies like di commonwealth and African Development Bank, go attend di event on Tuesday morning.
US president Joe Biden don delegate team wey go comot di US to attend di inauguration of di new Ghana president.
Inside one official statement from di White House, President Biden select Shalanda Young, director of US office of management and budget, Virginia Palmer, di US ambassador to Ghana, Karen Bass di Mayor of Los Angeles, Frances Brown, special assistant to di present and senior director for African affairs for di White House national security council.
Delegation from di European Union, di United Kingdom all don confam dia attendance, according to Oga Felix Kwakye Ofosu.
Swearing-in of di president
Na di Chief Justice of di kontri go conduct di oath of office to di new president.
Di swearing-in-ceremony go happun for di kontri Independence Square for Accra, di capital.
For 2017, dem swear in President Nana Akufo-Addo for di Independence Square, wey be one of di kontri national monuments.
However, for 2021, dem swear in Akufo-Addo for im second term for di Forecourt of Parliament House upon di request of di lawmakers.
Di lawmakers don tok say di law dey provide say make dem swear in di president “in front of parliament” na so dem want make dis happun inside Parliament House instead of oda places like di Independence Square.
But di transition team don prepare di independence square for di swearing in of John Mahama.
Oath of office of di president
Di oath na di affirmation wey pesin dey take bifor im go begin carry out di duties of di president for period of four years.
Dis oath don dey renewed evri four years afta di electoral commission bin declare results of di election wia dem gazette am.
For dis inauguration, di president go choose to use Bible or Quran.
All di presidents of di fourth republic been use di Bible to take dia oath.
Anoda item dem dey carry give di president na di state sword.
Dis sword dey represent say di pesin don rise to occupy di seat as president and im go pledge to protect and uphold di constitution of Ghana.
Afta di oath of office, di president go siddon for di presidential seat in di presence of di crowd and goment officials.
Dis seat na long tradition wey dem carve wit wood wey dem lay wit gold.
For Ghana, if di president die or dem remove am from office, or im resign, na di vice president dey take ova di mantle of office for di rest of di term of office afta di chief justice don swear am in.
Fotos from di swearing-in ceremony of John Mahama as Ghana president